| If you say you be colonial man
|
| You don be slave man before
|
| Them don release you now
|
| But you never release yourself
|
| I say you fit never release yourself
|
| Colo-mentality
|
| E be say you be colonial man
|
| You don be slave man before
|
| Them don release you now
|
| But you never release yourself
|
| E be so
|
| He be so them dey do, them dey overdo
|
| All the things them dey do (He be so!)
|
| E be so them dey do, them think dey say
|
| Dem better pass them brothers
|
| No be so? |
| (He be so!)
|
| De ting wey black no good
|
| Na foreign things them dey like
|
| No be so? |
| (He be so!)
|
| Dem go turn air condition
|
| And close Dem country away
|
| No be so? |
| (He be so!)
|
| Them Judge him go kack wig
|
| And jail him brothers away
|
| No be so? |
| (He be so!)
|
| Dem go proud of dem name
|
| And put dem slave name for head
|
| No be so? |
| (He be so!)
|
| Colo-mentality now make you hear me now
|
| Colo-mentality!
|
| Mr. Ransome you make you hear
|
| Mr. Williams you make you hear
|
| Mr. Allia you make you hear
|
| Mr. Mohammed you make you hear
|
| Mr. Anglican you make you hear
|
| Mr. Bishop you make you hear
|
| Mr. Catholic you make you hear
|
| Mr. Muslim you make you hear
|
| Na Africa we dey o make you hear
|
| Na Africa we dey o make you hear
|
| Colo-mentality hear
|
| Colo-mentality hear
|
| Mr. Ransome you make you hear
|
| Mr. Ransome you make you hear
|
| Na Africa we dey o make you hear
|
| Na Africa we dey o make you hear
|
| Colo-mentality hear
|
| Colo-mentality hear
|
| Colo-mentality! |