Lyrics Dem Mama - Timaya

Dem Mama - Timaya
Song information On this page you can find the lyrics of the song Dem Mama, artist - Timaya.
Date of issue: 06.01.2019
Song language: English

Dem Mama

I say they done come
(iyo, iyo, iyo, iyo, iyo, iyo)
Nothing we do them
(iyo, iyo, iyo, iyo, iyo, iyo)
Nigeria na my country oh
Bayelsa na my state oh
This na reality
Well e bin happen for Bayelsa oh
Nineteen Ninety nine oh
I swear I no go forget am oh
When them kill the people oh
And they make the children them orphans oh
Any time wey I think am oh
Water dey pour from my eyes oh
Somebody say make I leave am oh
But I say me I must talk am oh
I say them don kill them mama eh (eh eh)
Them don kill them papa eh
I say them don kill them mama
them papa them mama them papa them mama eh
I say they done kill them mama eh them papa eh ah
them mama eh ah
Wetin we go do iyo
Do iyo
Say do iyo
Na so them march dey go iyo
Ten thousand soldiers for road iyo
Ask them where them dey go
Them say them dey go Bayelsa oh
Which place for Bayelsa
One village they call Odi oh
Na im them enter our village
and rape our young girls
And make us homeless oh (chai)
Them kill our mama iyo
Them kill our ppaa iyo
Them kill our brothers
Them kill our sisters
And make us homeless oh
Wetin we go do iyo
Do iyo
Say do iyo
Everybody dey cry oh
I say Government them bad oh
I say them don kill them mama eh (eh eh)
Them don kill them papa eh
I say them don kill them mama
them papa them mama them papa them mama eh
I say they done kill them mama eh them papa eh ah
them mama eh ah
Wetin we go do iyo
Do iyo
Say do iyo
I don die oh
Poverty no good at all oh (chai)
Everyday for Nigeria
Na so the people them dey die oh
Eeeehhh, our government oh
Na why una make us dey cry oh
OOooh, everyday for Nigeria
Na so the people dem dey die oh
Them commot for house for morning oh
Money no dey for your hand oh
Police go stop you for road
Them go collect the one wey you get oh
Them lay allegation for your head oh
For wetin you no do iyo
Before you go know
My brother, you don dey inside cell oh
I say them don kill them mama eh (eh eh)
Them don kill them papa eh
I say them don kill them mama
them papa them mama them papa them mama eh
I say they done kill them mama eh them papa eh ah
them mama eh ah
Wetin we go do iyo
Do iyo
Say do iyo

Share lyrics:

Write what you think about the lyrics!

Other songs of the artist:

NameYear
Get My Money Right 2022
Joko ft. Shaggy 2023
Bum Bum Remix ft. Sean Paul 2018
I Don Blow ft. Sayo Pisanta 2018
Happy ft. Sir Shina Peters 2018
Bum Bum 2018
Good Life ft. Vector 2018
Who Born You ft. Wrecoba, Allenian & TJ 2 Solo 2018
Sexy Ladies 2019
Iyawo Mi ft. Gift, Grace 2018
Yankulu Ya ft. Gift, Grace 2018
Sanko 2019
Life Anagaga ft. M.IDe Rebirth 2018
Illuminati 2019
I Concur ft. Don Jazzy 2015
I Like The Way 2016
True Story 2018
Ukwu 2018
Watta Bambam 2018
Wayo People 2018

Artist lyrics: Timaya