| One day one day e go better for naija
|
| money go circulate, light go dey
|
| One day one day we no go need to ja comot naija
|
| Omo e don tey, I for like make e be today
|
| its still the same guys, still the same lies
|
| still the same breed, still the same greed
|
| still the same promise, ten years in office
|
| make no change, except for their pockets
|
| they really dont care, and we dont either
|
| we’d rather just chill, watch them decieve us
|
| trust in God, thats what they teach us
|
| to idolize leaders, ballers, preachers
|
| and dont ask questions or else they’ll kill
|
| watch them loot, they rob, they steal
|
| all the resources under our nose
|
| cant blame 'em its the position we chose
|
| we stay subdued, modern day slaves
|
| living like s#! |
| t in these modern day caves
|
| we must say no, thats the solution
|
| new day, new way, due revolution
|
| One day one day e go better for naija
|
| money go circulate, light go dey
|
| One day one day we no go need to ja comot naija
|
| Omo e don tey, I for like make e be today
|
| its been about 50yrs of this struggle
|
| its been a long time we’ve been on this hustle
|
| its almost as if say we no wan grow
|
| people dey lead us just to get dough
|
| cos if light no dey generator must sell
|
| and if you get gen you must buy fuel
|
| and to buy fuel no be small matter
|
| without borehole you no fit get clean water
|
| so poor man suppose to do business?
|
| how small child suppose to fight sickness?
|
| if for hospital, drugs no dey
|
| and if you get wound, you must first pay
|
| now our education don dey fall short
|
| all skilled workers just wan comot
|
| this kind system e no sustainable
|
| it is not sustainable
|
| One day one day e go better for naija
|
| money go circulate, light go dey
|
| One day one day we no go need to ja comot naija
|
| Omo e don tey, I for like make e be today
|
| Eh me I go yarn, i go still dey speak my mind
|
| for all the basic amenities my people dey find
|
| our children dey die, our wives dey cry
|
| and its all due to the corruption
|
| we must say no, no to all bad politicians
|
| no, no to bad government officials
|
| no, no to all man wey suppose dey work, we dey thief money
|
| healthcare is so bad, mortality rate is too high
|
| good road e no dey, for road my people dey too die
|
| clean water to drink, good house to sleep
|
| electricity and security
|
| my brother all these things na basic amenity
|
| na basic amenity. |
| G. O. Weli |