| Shey you never hear
|
| About the things wey happen there Abi your eye never clear
|
| Mankind so wicked
|
| Lets talk about my government open your mind and your ears Wetin happen
|
| Shey na jazz o
|
| Make my people suffer suffer All their nyanshes don dey open Everything don
|
| scatter scatter
|
| 20th of October 2020
|
| You carry army go kill many youth for Lekki
|
| Na so WATER OOO WATER runaway my eyes Nothing you go talk wey go justify the
|
| case of thir murder
|
| The chief of staff, th commander and the army wey carry order
|
| Mr President, Mr Governor
|
| Godfather, gbo gbo IJOBA
|
| All your atrocity
|
| All of your corner corner
|
| Make all the DEADBODY disturb you for your dream
|
| The money wey you thief yapa for your azza You don turn our graduates to common
|
| beggars All the book them go no matter
|
| Cuz you no go get job if you no know godfather
|
| The Chief of staff, the commander and the army wey carry order
|
| Mr President, Mr Governor
|
| Godfather, gbo gbo IJOBA
|
| All your atrocity
|
| All of your corner corner
|
| Make all the DEADBODY disturb you for your dream
|
| 20th of October 2020
|
| You carry army go kill many youth for Lekki
|
| Na so WATER OOO WATER runaway my eyes Nothing you go talk wey go justify the
|
| case of their murder
|
| We give them many chances Dem FAIL my people
|
| And When we cry for justice Them kill my people
|
| Walahi ALL of YOU
|
| Their lives are on you
|
| We no go ever forget all the youths Wey die for TOLLGATE |